Bobrisky
Di Minister of Interior, Hon. (Dr.) Olubunmi Tunji-Ojo, don direct unconditional and comprehensive investigation into di allegations of bribery and corruption within Nigerian Correctional Service (NCoS).
Dis dey come afta Nigerian activist Very Darkman allege say Bobrisky bin pay 15 million to shun prison sentence.
For one statement wey BBC News Pidgin take eye see, di minister condemn di alleged behaviour and emphasise say any form of "indiscipline, unprofessionalism, and corruption go dey met zero tolerance and severe consequences within di paramilitary services under di Ministry’s purview".
Di minister tok say im ministry no go tolerate any compromise on dia core values of integrity, transparency, and accountability.
"We no go leave no stone unturned in rooting out corruption and ensure say dose found culpable face di full wrath of di law,” Dr. Olubunmi Tunji-Ojo tok.
Di Minister don set up a special investigative panel headed by di Permanent Secretary of the Ministry of Interior, Dr. Magdalene Ajani, to probe these allegations and submit a comprehensive report.
Oda members of di committee include Dr. Uju Agomuoh of Prisoners’ Rehabilitation And Welfare Action (PRAWA) wey go serve as di Secretary; Mrs Eva Omatese, Director of Legal Ministry of Interior; Mr. Usman Nasiru, Director of Joint Services Ministry of Interior; and Dr. Ikechukwu Ezeugo (Consultant Iyke) of The Brekete Family Show.
Di Minister reassure di public say di investigation go dey rigorous, transparent, and impartial, and say appropriate disciplinary actions go happun against any personnel wey dem find guilty.
Credit: BBC
Disclaimer